(A Resurrection Poem in Pidgin English)
by Funmilola Awogbade
Dem put am for tomb, lock am wella,
Dem tink say na di end be dat.
But early momo, E rise from di dead,
Tomb empty—light don come.
Jesus na di Light wey no fi burn or break like electric bulb,
Him break di chains wey death don lay.
Cross stand gidigba on top dat hill,
No just be wood—na love and sacrifice.
E collet our burdens,
Con give us rest and eternal life.
Him blood dey speak pass loud speaker,
E clean our sins, con make us white pass snow.
From cross to grave, to sky above,
Na proof say God love us unconditionally.
So make you no fear when life dey hard,
Remember say Jesus go always dey for you.